
16 February 2023
Manchester United forward Marcus Rashford kontinu im impressive form as dem face Barcelona for Spain for di Europa League first round of dia knock-out game.
Rashford be like di player wey make di difference between di two teams.
Raphinha hit back for Barcelona but e no dey enof to secure victory for di host wey bin look like say dem go dominate di game afta di first 20 minutes of di first half.
Di Spanish giants host United on Thursday for di first leg of dia Europa League knockout-round play-off.
But di two teams now get evri tin to play for in di return leg.
Ten Hag get appointment as United coach for summer and e don quickly make im mark, wit di Red Devils flying high for di Premier League and also for di Carabao Cup final.
Second half
Barcelona 2-2 Man United
90+5mins: FULL TIME
90+1mins: Alejandro Balde receive brilliant pass and waste a big opportunity.
90mins: Marcus Rashford hit shot towards di bottom left corner from di edge of di box, but na weak attempt.
87mins: What a wasted opportunity by Ansu Fati
85mins: Di free kick from Ansu Fati fail to provide any scoring opportunity, as one of di defenders do good job and knock am out.
84mins: Casemiro commit rough challenge and Maurizio Mariani blow im whistle for foul.
83mins: SUBSTITUTION. Ferran Torres enta for Raphinha.
82mins: SUBSTITUTION. Alejandro Garnacho enta for Jadon Sancho
80mins: Frenkie de Jong launche cross from di corner, but David de Gea thwart di effort.
79mins: Marcus Rashford receive well-played pass inside di penalty area and shoot.
Barcelona 2-2 Man United
76mins: GOAL! Great link up play between Raphinha and Jules Kounde give Raphinha clear sight of goal
73mins: YELLOW CARD to Gavi for a foul
72mins: Aaron Wan-Bissaka sends cross into di box, but Marc-Andre ter Stegen gather di ball.
68mins: Robert Lewandowski fail to convert mid-range free kick and send di ball narrowly over di bar.
67mins: SUBSTITUTION. Andreas Christensen enta for Marcos Alonso. Ansu Fati enta for Franck Kessie and Alejandro Balde enta for Jordi Alba.
66mins: YELLOW CARD for Casemiro
65mins: Maurizio Mariani blow im whistle for foul against Fred
62mins: Aaron Wan-Bissaka receive sweet pass inside di box, but dem block im effort on goal
Barcelona 1-2 Man United
Second goal! Barcelona Jules Kounde score di own goal.
58 mins- Barcelona Frenkie de Jong try to cross to find one of im teammates, but United block di cross.
55 mins- Barcelona Raphinha fire shot im for score but Man United goalkeeper save im shot.
53 mins- 1 - 1
Na fine goal by Manchester United Marcus Rashford
Goal! Na from corner Marcos Alonso of Barcelona head di ball inside di net.
47 mins- One of di defenders do last minute blocking from Barcelona Ronald Araujo.
46 mins- second half don start.
First half
Barcelona 0-0 Man United
45 mins- Gavi of Barcelona play fine cross, but United don clear di ball.
43 mins- Maurizio Mariani don give Raphael Varane of Manchester United a yellow card for foul.
41 mins- Xavi dey forced to make substitution sake of Pedri injury and Sergi Roberto don enta
41 mins- Dem don stop di game afta Pedri if Barcelona go down, di Phsio dey check am
39 mins- Di corner from Raphinha Manchester United defence clear am
36 mins- Marcus Rashford of Manchester United don commit foul after foul Barca player.
34 mins- Marcus Rashford of Manchester Unite) collect low pass inside di box, im controls di ball and releases am towards di right post. Unfortunately for him, Marc-Andre ter Stegen make great save to stop im effort.
33 mins- Luke Shaw of Manchester United play di corner kick and e look like say im go swing di ball inside di penalty box.
30 mins- Di free kick inside di box finds Casemiro of Manchester United, e direct im header inside di middle of di goal, but di keeper save am . good goalkeeping.
29 mins- Franck Kessie of Barcelona do rough challenge and Maurizio Mariani don blows im whistle for foul.
28 mins- Casemiro of Manchester United deliver fine cross inside di box, but Barca clear am.
23 mins- Gavi of Barcelona don give away a foul from bad challenge. Referee Maurizio Mariani see di whole tin.
22 mins- Luke Shaw of Manchester United step up to take di corner, but the ball just pass among di defenders.
20 mins- Jordi Alba of Barcelona cross ball inside di box, but e dey too close to David de Gea.
19 mins- Raphinha of Barcelona bin get great chance inside di box afta di ball fall off a defender, but somehow e no connect wit di ball well e fire im short ova di bar.
18 mins- Tyrell Malacia of Manchester United play rough as im try to win di ball from im opponent. Maurizio Mariani been see wetin happun and e blow im whistle.
15 mins- Jordi Alba of Barcelona play low pass from just outside di box to find im teammate, but one of di defenders calmly clear am.
14 mins- Di referee blows im whistle as Fred of Manchester United bin dey too aggressive for im challenge.
12 mins- Dangerous play by Fred of Manchester United. Maurizio Mariani blows im whistle for a foul.
11 mins- Gavi of Barcelona play fine cross inside di box, but di opposition defence block di ball and kick am away.
9 mins- Barca attack find Robert Lewandowski for inside box. But David de Gea save im shot
8 mins- Flag up against Jadon Sancho of Manchester United. Im bin get space to move into behind di defence, but him go too soon.
3min: Rough tackle by Fred (Manchester United). dI referee blows im whistle for foul.
5mins: Raphinha for Barcelona try to break free, but im control let am down im don lose di ball.
1min: Pass by Bruno Fernandes no reach im teammate, di attacking play don end.
Di players don enta pitch to listen to di anthem ahead of kick-off
Barcelona vs Man United predictions

Football sabi pesin Bolarinwa Olajide say Barcelona get evri right to dey confident for dis game against Manchester United.
"But again dem play against a United side wey dey in form too.
"I feel say di game go dey very tight, both sides go dey very careful not to make too many mistakes."
Prediction: 1-1
Fans fit watch di match for Supersports on DSTV if you wan watch am for Nigeria and Ghana.
BBC Pidgin go also give live updates of di match.
All di games go kick off by 9:00pm West African Time.
Barcelona vs Man United line-ups
Barcelona team news
Starting line-up: Ter Stegen, Kounde, Araujo, Alonso, Alba, De Jong, Kessi, Pedri, Gavi, Raphinha, Lewandowski.
Subs: Pena, Tenas, Fati, Torres, Christensen, Roberto, Garcia, Balde, Casado, Torre, Alarcon.
Man United team news
Starting line-up: De Gea; Wan-Bissaka, Varane, Shaw, Malacia; Casemiro, Fred; Sancho, Fernandes, Rashford; Weghorst.
Subs: Heaton, Butland, Lindelof, Maguire, Dalot, Pellistri, Elanga, Garnacho, Iqbal, Mainoo.
Form guide
Form (for all competitions, di most recent first): WWWWWW
Wia dem dey for table : 1st for Spanish Liga, Copa del Rey semi-finals
Man United
Form: WDWWWW
Wia dem dey for table: 3rd for English Premier League, FA Cup round of 16
Wetin di coaches tok?
Xavi Hernández, Barcelona coach tell Uefa say: "Dis go be a good game, na ogbonge tie for di neutrals.
Both teams dey dia best form all season. Ten Hag don change dis team. E bin dey difficult at first, but im dey do excellent job. Dem be dangerous team wit physical fortitude; dem get plenty threats and e go dey difficult. I expect plenty ginger, high tempo – exactly wetin you go expect from English sides."
Erik ten Hag, Man United coach tell Uefa say: "I feel say Barça na also a difficult club [to manage] but I feel say dem dey play dia best football…— you go see Cruyff influence here.
Dem dey defend well but I tink dia biggest skill na dia possession. To quote Johan Cruyff: 'Wen you get di ball, di opponent not fit score'."
Dey refresh dis page for live updates of di match
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomqlrqq%2FGs8XLpWuo